Authority Stealing Lyrics

lyrics
Browse : 0-9 A B C D E F G H I J K L M N O P Q R S T U V W X Y Z | ALL

Authority Stealing lyrics

Fela Kuti


Correct Authority Stealing Lyrics Correct these lyrics
Print Authority Stealing Lyrics Print these lyrics
Comment LyricsComment lyrics
Rate this song:
1 2 3 4 5
No votes yet, be the first!

Add to my playlist
Artist: Fela Kuti lyrics
Title: Authority Stealing

Send "Authority Stealing" to your Cell


Lyrics to Authority Stealing :
[Chorus]
Authority stealing!

You be thief (I no be thief)
You be rogue (I no be rogue)
You dey steal (I no dey steal)
You be robber (I no be robber)
You be armed robber (No be armed robber)

I no be thief (You be thief)
I no be rogue (You be rogue)
I no dey steal (You dey steal)
I no be robber (You be robber)
I no be armed robber (You be armed robber)

[Chorus]
Argument, argument!

Argument, argument, argue
Them argue
Everbody dem argue
Them dem dem argue
Up and down them argue
Everbody dem argue
Them dem dem dem argue
Yes yes, them argue
Everbody dem argue

Argument about stealing
Somebody don take something
Wey belong to another person

Then you go hear:
You be thief (I no be thief)...

On top of the road, on the side
People dey waka
Office workers, labourer workers, workers' workers
Them go dey waka
Inside bus them go dey
Motorcycle them dey ride
Plenty, plenty crowd
Inside this crowd
Sometimes for one corner
Sometimes for one street
You go dey hear: ha ha!

[Chorus]
Thief, thief, thief!
Rogue, rogue, rogue!
Robber, robber!

Catch am, catch am! Thief, thief, thief!
Catch am, catch am! Rogue, rogue, rogue!
Catch am, catch am! Robber, robber!
Catch am
Pull am
Get am
Keep am
Ole...

[Chorus]
Catch am, catch am!

Looking go start
Watching go start
Chasing go start
Somebody go dey
Wey them go grab

Them go beat am well-well
Them go lynch am well-well
Police go come well-well
Them go carry am go court
Them go put am for jail

Them fit put am six months
(Them go put am for one year)
Them fit put am two years
(Them go put am for five years)
Them fit put am seven years
(Them go put am for ten years)

If not them go shoot am well
Them go shoot am for armed robbery
On top of the road, on the side
People dey waka
Office workers, labourer workers, workers' workers

Them go dey try
To try to make ends meet
Them go dey hustle
To try to make ends meet
Them go put hands for back
To try to make ends meet
Them go dey beg oga
To try to make ends meet
Them go be slaves for them town
To try to make ends meet

I say turn your face small
To the right wing
Oga patapata dey for there
Authority people dey for there
Instead of workers
We have officials
Instead of buses
Them dey ride motor-car
Instead of motorcycle
Na helicopter
Instead of them waka
Na worker go waka for them

Authority people them go dey steal
Public contribute plenty money
Na authority people dey steal
Authority man no dey pickpocket
Na petty cash him go dey pick
Armed robber him need gun
Authority man him need pen
Authority man in charge of money
Him no need gun, him need pen
Pen got power gun no get
If gun steal eighty thousand naira
Pen go steal two billion naira

[Chorus]
Thief, thief thief!
Rogue, rogue, rogue!
Robber, robber!

You no go hear them shout
You no go hear them shout at all
You no go hear them say
You no go hear them say response at all

Na different way be them way
Na civilize style be them style

[Chorus]
Yes, yes, yes, yes!

"Oh yes, of course, contract, have some money back in hand, ha ha"
Hear the words them dey take deceive the people:

Misappropriation
Maladministration
Nepotism
Mitigation
Make I remember another one wey them dey use
Defraudment
Forgerylization
Embezzlement
Vilification
Mismanagement
Public inquiry

Authority stealing pass armed robbery
We Africans we must do something about this nonsense
We say we must do something about this nonsense
I repeat, we Africans we must do something about this nonsense
Because now authority stealing pass armed robbery

Authority man him go dey steal
Public contribute plenty money...

[Chorus]
Authority stealing!

[ These are Authority Stealing Lyrics on http://www.lyricsmania.com/ ]

Send "Authority Stealing" to your Cell

Comments to these lyrics

Leave a Comment

No comments to these lyrics yet, be the first!
Top Lyrics
Ed Sheeran - Lego House lyrics
Of Monsters & Men - Little Talks lyrics
Bon Iver - Skinny Love lyrics
Fray (The) - How To Save A Life lyrics
Mumford & Sons - The Cave lyrics
Mumford & Sons - Little Lion Man lyrics
Foster The People - Pumped Up Kicks lyrics
Young The Giant - Cough Syrup lyrics
Amy Winehouse - Valerie lyrics
Taylor Swift - You Belong With Me lyrics
Edward Sharpe & The Magnetic Zeros - Home lyrics
Mumford & Sons - White Blank Page lyrics
ZAZ - Je Veux lyrics
Kimbra - Settle Down lyrics
Wallpaper. - FUCKING BEST SONG EVERRR lyrics
Corinne Bailey Rae - Put Your Records On lyrics
Adele - Someone Like You lyrics
Mumford & Sons - Awake My Soul lyrics
Angus And Julia Stone - Big Jet Plane lyrics
Jesse & Joy - Corre! lyrics
Secondhand Serenade - Your Call lyrics
Gotye - Eyes Wide Open lyrics
Don Omar - Danza Kuduro lyrics
Fray (The) - Look After You lyrics
Mike Posner - Cooler Than Me lyrics
Colbie Caillat - Bubbly lyrics
Red Jumpsuit Apparatus (The) - Your Guardian Angel lyrics
Mumford & Sons - Roll Away Your Stone lyrics
Far East Movement - Like A G6 lyrics
A Day To Remember - If It Means A Lot To You lyrics
Brandi Carlile - The Story lyrics
Flobots (The) - Handlebars lyrics
Asking Alexandria - Not The American Average lyrics
Kings Of Leon - Use Somebody lyrics
Mumford & Sons - After The Storm lyrics
Pistol Annies - Hell on Heels lyrics
Flight Facilities - Crave You lyrics
Gotye - Somebody That I Used To Know lyrics
Radical Face - Welcome Home lyrics
Two Door Cinema Club - Something Good Can Work lyrics
Adele - Rolling In The Deep lyrics
Asking Alexandria - The Final Episode (Let's Change Channel) lyrics
Peter Bjorn And John - Young Folks lyrics
30 Seconds To Mars - This Is War lyrics
Foster The People - Helena Beat lyrics
Fray (The) - Never Say Never lyrics
AJ Rafael - We Could Happen lyrics
Plain White T's - 1234 lyrics
Stromae - Alors On Danse lyrics
Carla Bruni - Quelqu'un M'a Dit lyrics
Play This Song